FOR SALE, NOT FOR FREE

FOR SALE, NOT FOR FREE

Dear Rising Artistes,
On a dailies, you've been a farmer, 
Clearing the bush, tilling the soil,
Planting the seeds, watering the seeds,
But whenever, it's harvest time;
You automatically, become a philanthropist,
Giving out your sweat for free of charge;
Your aka for the street now na, "Oga OshoFree",
That's why they never value your art,
Because they can access it for free.

My guy, what's up? 
Shey you be artiste?
Since wey you dey share your Songs for free
Like Party Rice, how many people don pay you
Moni wey carry politician belle?
Because of say, dem see you finish,
Even when dem suppose pay u,
Dem go lick you with lie say,
"Dem dey give you platform."
My guy, who platform help?
All the platforms wey dem don give us,
E be like say na Bacha, because e no dey last.

My guy, diz pipu don too use our head do moni merisin,
Shey dem go pay DJ, pay for Stage, pay for Canopy,
But when e reach to pay us,
Story go become Superman pass Wale Adenuga.
Therefore, my guy, the earlier you say "No! To Free Shows!",
The better your career go add weight like ajebota;
But if you want remain Hungry Artiste, congrats.

My guy, you no be suffer head!
No give your songs/poetry for free,
Ask for moni or him brother.
No perform for free,
Ask for money or him brother.

If you no carry yourself,
You go become dia footmat.
Dem go drink you finish,
Troway u for gutter:

My guy, price yourself oo,
Make dem no turn u to crayfish market.

Download Ungbemgbe here: 

Download on CD Baby:

Listen on SoundCloud 

Stream/Download on iTunes:

Download on HearNow:

Pay & Get Ungbemgbe

#2WYTH #gbeduPoet #Ungbemgbe #JustBikeIt #wakawakapoet #ph2eko #abrahamsjourneywith2wyth #lagospoet #poetsinlagos #globalpoet #gbeduPoetry #gbeduPoetry2DWorld #ForSaleNotForFree #poetry #dancepoetry #dancepoet #billionairepoet #UsokunAmbassador 

Comments

History of Ungbemgbe

MY AFRIMA AWARDS 2019 REVIEW

DEAR FUTURE by #gbeduPoet